I am Mr. Cassava and people dey prepare me in many ways
IGBO PEOPLE
Igbo people dey prepare me as akpu very white and neat but wetin dey pain me be say upon how white wey I dey dem go soak me inside water until I decay until dem go think say I don dey useful, but na so so smell I go dey smell, even after eating me and you apply your expensive perfume i go still over shadow ram.
The one wey pain me pass be say people go prepare me finish and keep me under the rain and sun at Amorji junction by PH express road for one week after that they will carry me to Ahia Nkwo Ngwa where dem go drop me beside the gutter, water from gutter go dey touch me.
But that one no matter at all people still dey buy me dey eat me front and back even person wey dey write dis thing akpo na em best food.
YORUBA
Yoruba people dey pill me keep me for sun sotee I go black before dem go think say i go dey useful.
Every day na so so sun sun dem go dey sun me and spray me where people dey pass any how any how, after preparing me dem go call me Amala.
But my happiness be say even if yama yama dey inside me people go still dey eat me because I black nah dey no go fit see any yama yama inside.
But something dey vex me small, why must dey add stew to soup, i beg dat mixture dey vex me.
DELTA STATE
Na dem dey prepare me as starch, I don’t have kasala with that, because na dem understand the economy of this country pass.
Starch wey other people dey throw way na em dem dey use prepare their food.
I beg how una dey prepare me in your own area?